Ecuador defender Mario Pineida don kpai

We don dey hear now say Ecuador defender Mario Pineida don kpai after some bandits on top bike open fire on am in front of one shop wey him wan buy sontin. According to the tory, Mario dey with him mama for the front of the shop when these people suddenly land their with their bike like bandit, point their machine gun for Mario begin shoot am right there in front of him mama. Immediately naim area scatter as people begin run left right and center. After the shooting na so dem ride away and before dem rush Mario reach hospital the guy don kpai. 

We also hear say that area wey this thing happen na the kaban of gang violence because cultists, drug dealers, kidnappers, hire killers, even bandits and Boko Haram, na that area be their Sambisa. And for dem to target this guy so, some people don dey suspect say the guy fit don go chook hand inside something wey him no suppose wey make dem find am shoot am like Amadou Diallo.

My people diswan shock everybody. Abeg na wetin you get to talk for this matter so?

Post a Comment

0 Comments