Vini junior don tell oga presido Perez say he no sign contract

We don dey hear now say Real Madrid star boy, Vini Junior don tell the president, Florentino Perez say him no ready to sign new contract with Real Madrid because him don made up him mind say him no wan play under Xabi Alonso again. According to the tory, Real Madrid wan increase Vinicius salary from 18 million euros to 20 million per year but Vini don tell dem say even if dem increase am to 200 million, as long as Alonso remain the coach of Real Madrid, make dem forgerabourit. Una know say Vini and Alonso don dey get kwanta since wey make many people begin wonder whether the two of dem dey drag girlfriend abi Vini hide go give Alonso daughter bele.  As a result Alonso no dey give Vini playing time and whenever anything go wrong na him the coach go blame. And now Vini sef don kuku taya for the Tom and Jerry wey the coach use him career take dey play and him don tell the presido say make dem choose between him and Alonso who dem want to leave the club.

My people shay you go support make Vini leave the babe for Alonso abi make him show say na man him be by remaining there to fight for her?

Post a Comment

0 Comments