Eberechi Eze become the first player to score hat trick for Premier League North London derby after him goals help Arsenal destroy Tottenham 4-1 for dem match wey shele this evening for Emirates. Na Merino use one correct GPS take locate Trossard to use one deflected shot make am 1-0 for Arsenal. 5 minutes later naim Eze carry masquerade enter market square when him scatter Tottenham defence waya one correct shot inside net make am 2-0 for Arsenal after first half. Second half never even start when the same Eze use left leg shot take scatter net to make am 3-0. Zubimendi decide to do promo for Richarlison to lob the ball above keeper to make am 3-1 with one beautiful goal. But Eberechi Eze show say him get bad plans for Tottenham when e collect one ball from Trossard, cancel one defender before using sweet R2 take make am 4-1 to become the first player to score hat trick for North London derby for Premier League and help Arsenal open 6 points on top table.
My people how una see this kind pepper wey Eze rub Tottenham for eyes so?


0 Comments