Arsenal thrash bayern 3-1 for their ucl clash

Arsenal show say dem fit father anybody for Europe after dem beat Bayern Munich 3-1 to end their 18 matches unbeaten run. Arsenal show say na dem be King of corner after Jurien Timber head one sweet corner inside net to make am 1-0. But Bayern no ready to give up as dem use one long ball take beat Arsenal defence for 17-years old Karl to make am 1-1. Arsenal enter second half with new dance as dem no even allow Bayern pass halfway line as dem just dey press Bayern neck until Carlafiori use one sweet cross take locate Madueke to make am 2-1 for Arsenal. When Bayern dey hope to equalise again naim Martinelli turn to Usain Bolt run pass all the Bayern defence including keeper to score into empty net make am 3-1 and fire Arsenal straight to the top of the table. Arsenal play Bayern ball sotay dem fans carry banner say fock UEFA for giving dem Arsenal.

Goal surplus for the other matches wey shele today starting with Liverpool wey the juju wey follow dem continue to dey increase in power as PSV destroy dem 4-1 for Anfield. PSG and Tottenham wan kpai each other with goals as PSG outscore Tottenham 5-3. Real Madrid manage beat Olympiacos 4-3. Atletico beat Inter 2-1 while Ademola Lookman score the first goal wey Atalanta take beat Frankfurt 3-0.

My people how una see wetin Arsenal do Bayern tonight so?

Post a Comment

0 Comments