uefa champions league day 5 update

Chelsea use Barcelona take catch cruise today after dem disband and dismember dem for dem UCL match wey shele this night. Na Barcelona carry gun begin shoot demsef for leg after Jules Kounde first go do own goal make am 1-0 before Araujo go collect red card. Na for second half naim Chelsea begin score after Estevao use one wonderful solo goal take make am 2-0 before DeLap score tap in wey ref first cancel before VAR approve am 3-0. 

For other matches wey shele tonight, Manchester City fall their own hand as Bayer Leverkusen hammer dem 0-2 for Manchester. Newcastle squander 1-0 half time lead as former Arsenal skippo Aubameyang score 2 goals in 5 minutes for Marseille to beat dem 2-1. No Osimhen, no goals for Galatasaray as Union Gilloise beat dem 0-1 for Turkiye while Naija blood Karim Adeyemi score the third goal wey Dortmund take beat Villarreal 3-0. 

My people which kind pepper naim Chelsea chook for Barca eyes so?






                                                DROP YOUR COMMENT BELOW.......... 

                                                                Like Us On Facebook
 
                                                                 Follow  Us On Twitter 


                                          


                                           Follow Us On Instagram

Post a Comment

0 Comments