Fans tackle Robin Van Persie after bringing on his son when losing 3-1

As Robin van Persie dash him 19-years old son him senior debut for Feyenoord when dem dey lose 3-1 to Celtic, and as fans don dey tackle am say:  why you go use imammadu take bring in your inexperienced pikin for match wey we dey lose wey we need goals, van Persie don come outside dey defend himself and him son say: thank God say na una talk am say we need goals. So as a coach, we dey find goals and I bring in young and hungry striker. Abeg ma wetin dey wrong there? Abi na because the striker now happens to be my son? Mbanunu, make una no look am like that. Forget say na my pikin be that, that boy na Omekannaya and him sabi score goal from any angle. Whether na straight shot, R2, curve ball, even tap in and head in, the boy sabi score goals. Unfortunately him no score any goal last night but at least him get one shot on target to show you say him get eyes for goal. Na true say the boy na my son, and as lion no dey born goat, una suppose know say the boy sharp like him old man which is why I bring am in.

My people shay van Persie explanation make sense abi him no suppose bring him inexperienced son in when dem dey find goals?






                                                DROP YOUR COMMENT BELOW.......... 

                                                                Like Us On Facebook
 
                                                                 Follow  Us On Twitter 


                                          


                                           Follow Us On Instagram

Post a Comment

0 Comments