Arsenal show say dem no come UCL come play okoso after dem destroy and discalamulate Atletico Madrid 4-0 for dem match wey shele this night. First half end 0-0 wey make many Ikorodu analysts begin predict the match to end for draw. But na for second half Arsenal begin perform miracle. Be like nobody advice Atletico say Arsenal na setpiece wizards as dem allow Gabriel of all people to connect with Rice setpiece to make am 1-0. E no tay when Lewis-Skelly use one wucked solo drive attack Atletico before dropping the ball for Martinelli to curve one sweet R2 make am 2-0. Atletico still dey wonder wetin dey happen when Gyokeres use by fire by force take bundle the ball inside to make am 3-0 with him first UCL goal for Arsenal. Of course Arsenal mind no dey rest if dem never score from corner kick and na that corner naim Gabriel take drop the ball for Gyokeres to lap the ball inside net make am 4-0 and make sure say Arsenal don collect 9 points from 3 matches score 8 goals and concede zero.
For the other UCL matches wey shele today, Haaland score for the 12 straight matches for both club and country as Man City beat Villarreal 2-0. Barcelona use provocation take destroy Olympiacos 6-1 with Marcus Rashford scoring 2 goals to prove say na Manchester United been dey hold am back. Newcastle destroy Benfica 3-0 while Ballon D’Or winner Ousmane Dembele score after only 3 minutes as PSG hammer Bayer Leverkusen 7-2.
My people how una see this kind power wey Arsenal dey show so?

0 Comments