PSG and Barcelona escape enter semi final of UCL after dem win 5-4 and 5-3 on aggregate despite losing their second leg matches.
PSG first show say dem no come England for shere-were when dem rush Villa with 2 early goals to make am 5-1 on aggregate. Na then Rashford and him teammates catch fire begin press PSG until Tielemans pull one back make am 2-1. McGinn use one balabu and bulaba shot take scatter net make am 2-2 before Rashford drop one sweet ball for Konsa to flash am in make am 3-2 for Villa and 5-4 on aggregate for PSG. But na there dem power end and even though dem get other opportunities to score, e just no happen for dem.
As for Barcelona, na Guirassy score hat trick wey Dortmund take beat dem 3-1 and even Barca goal na own goal.
My people how una see tonight matches so?
0 Comments