Martin Exit


No be small sontin shele for Scotland league after police turn to bodyguard take smuggle Rangers coach Russell Martin out of stadium to protect am from fans wey wan beat am. According to the tory, Rangers appoint Martin 3 months ago with the hope say him go help dem collect league from Celtic this season. But since him come na so-so draw him just dey play sotay people begin wonder say is it for okro soup abi ewedu? Out of 6 league matches Martin don draw 4, win 1 and lose 1 wey make Rangers dey 9th for table then, 9 points behind Celtic wey dem wan collect league from. Na diswan make Rangers fans give am that ultimatum say that yesterday match against relegation team Falkirk na must win and anything wey no be 3 points, make him no come out from that stadium. Match start Rangers dey win 1-0 until dying minute wey dem go allow Falkirk equalise to play another draw. Na diswan make Rangers fans gather outside some carry plank, cutlass, hammer, even 2 by 2, 4 by 4 and 10 by 10, na so dem gather outside dey wait make the coach come outside make dem use him body take check something. But police quickly suspect wetin wan happen so dem remove the coach from the team bus, put am inside special police car use escape am from the stadium. E no tay naim Rangers announce say dem don kukuma sack the coach to save am from beating because those Rangers fans can turn up anywhere and as we all know, vawulence is the name of any person, animal, place or thing and e fit occur anywhere.

My people how una see dis kind matter for Rangers so?






                                                DROP YOUR COMMENT BELOW.......... 

                                                                Like Us On Facebook
 
                                                                 Follow  Us On Twitter 


                                          


                                           Follow Us On Instagram

Post a Comment

0 Comments